Back
Kidnappers Don Kill Retired Navy Admiral Daughter, Driver Inside Kogi
Jul 10, 2020
Gunmen wey dem suspect to be kidnappers don shoot dead di daughter of one retired Navy Rear Admiral, J Onubi, and him driver along di  Lokoja-Abuja highway.
Di driver wey dem identify as Pomtd Lifu Ji with navy number X9307. Dia deadibodis don since dey transfad to di Federal Medical Centre, Lokoja.
SaharaReporters bin gada say di Onubi orderly, Osca Ahmadu, wey dey inside di same vehicle with di victims, escape enta di bush.
Di incident bin happun hours afta one unidentified naval officer and one woman inside camouflage bin killed along di same highway.
On July 7, one Nigerian Army officer, GSM Abubakar, wey dey attached to di 353 Artillery Regiment, bin also kpai on di notorious Okene -Lokoja highway, while dem dey travel from Lagos to di Armed Forces Command and Staff College, Jaji.
As SaharaReporters take nack di tori, gunmen on Thursday bin kill one navy officer and one woman inside camouflage along di Lokoja-Okene Expressway inside Kogi State.
64Shares
5Comments
0Favorites
36Likes
Say something to impress...
Loading...
Comments
Hot

No content at this moment.

Relevant people
Beta Talk
249470 Followers
News report and Lifestyle in Pidgin
Related