Back
UNN Graduate Don Kpai Afta He Nack Him Head For Ground While He Dey Play Ball
Aug 4, 2020
One 2018 graduate of University of Nigeria, Nsukka (UNN), Ogbonna Nnaemeka, on Sunday bin kpai of complications from one head woundjury wey he bin sustain while he dey play football inside Nsukka.
Di graduate of Sociology/Anthropology bin dey among di 2019 batch A Corp members wey pass out from di scheme for March.
Ogbonna Nnaemeka bin dey play football con nack him head ontop of di ground afta he miss him footing while he dey go for one headed ball for di Umudikwu village playing field inside di Nsukka.
One padi of Nnaemeka wey be one eye witness, Ani Peter, bin tell Vantage News say Nnaemeka bin show earlier signs of concussion but bin dey shapaly attended to by teammates wey pour water ontop him head and con buy one energy drink wey he bin take and con sit down to rest.
Moments later, he con start to dey convulse and dem rush am to Divine Mercy hospital wia efforts to save him life bin prove abortive.
Ani con blame di hospital as dem no show signs of urgency and for profeshunal misconduct.
“Di Dokintar bin no dey on duty when we bin bring Nnaemeka to di hospital. DI nurses as he see him condition con start to shout ‘Jesus’ and dey call di Dokintar wey come two hours later, dey sight faulty car battery as reason for him delayed arrival”, he yarn.
Afta dem pronounce am dead for di  hospital, di family con start to dey make arrangements to transport him deadibodis to dia village, Amutenyi, Obollo Eke, Enugu state for burial.
13Shares
3Comments
4Favorites
3Likes
Say something to impress...
Loading...
Comments
Hot

No content at this moment.

Relevant people
Beta Talk
249470 Followers
News report and Lifestyle in Pidgin
Related