Back
SEE PLENTY LOVE O! Burna Boy Woman Don Dey Celebrate Am With Strong Message
Jul 2, 2020
Ogbonge british rapper wey be Stefflon Don don go her social media to take celebrate her man wey be Naija singer, Burna Boy on him 29th Birthday.
We remember early today wey be July 2 say some Burna Boy fans them bin go twitter to take celebrate the singer for him birthday.
Him girlfriend don also join plenty fans them to celebrate him man for Instagram as she also rain beta words on am.
WATCH! BOVI DEY INNOCENT MAN (COMEDY SKIT)
For her words: ''Love your a$$ forever and a day my sweetie pie cake. Guys make una go wish Burna Boy Happy Birthday! #MyHeart”.
Stephanie Victoria Allen wey plenty pipu bin known as Stefflon Don nah british rapper, singer and even songwriter wey turn ogbonge afta her 2017 single ''Hurtin me'' wey she bin feature French Montana peaked for number 7 on United Kingdom single chart.
93Shares
5Comments
3Favorites
21Likes
Say something to impress...
Loading...
Comments
Hot

No content at this moment.

Relevant people
Beta Talk
249466 Followers
News report and Lifestyle in Pidgin
Related