Back
Accident On Benin Ekpoma-Auchi Road: 2 Pikins, 6 Odas Don Die
Jul 14, 2020
Two pikins and six adults reportedly bin lose dia lives inside one road crash on Saturday for Urkhuosa area on di Benin Ekpoma-Auchi road, BlitzPaper bin yarn for dia report.
Di tragedy wey bin happun involve one Toyota Haice bus and one articulate truck as residents wey live around di area cry well well over di horrible sights.
As dem furda gada, di accident bin happun when one of di vehicles dangerously overtake one anoda and get one head on collision with one oncoming vehicle.
Witness told BlitzPaper say eight person kpai on di spot while di police bin rush dos wey woundjured to hospital. 
Di Sector Commander of di Federal Road Safety Corps, Edo Command, Mr Henry Benamaisia, yarn eight persons bin kpai inside di accident while four oda bin sustain woundjuries dey receive treatment for one undisclosed hospital.
He yarn say police dey carry out di rescue operation, dey note say investigation dey ongoing to ascertain di cause of di accident.
He con advise motorists to exercise caution while dem dey road, especially during wet season.
29Shares
6Comments
2Favorites
18Likes
Say something to impress...
Loading...
Comments
Hot

No content at this moment.

Relevant people
Beta Talk
249469 Followers
News report and Lifestyle in Pidgin
Related